MAPOLY JOKE #LMAO#

HOSTEL:

At last mapoly saviour don come oh and
na all of una knw say anything this man
talk in go do am u remember say in
migrate students wey no pay school fées
quick, plus close portal as in talk ...so
make una dey rejoice oh ...but hope we
no go que collect room sha!


QUE:

Na mapoly u go que buy pure
water,check result ,que collect project
supervisor,que enter upper credit,que enter shuttle.que
toast beb,que graduate ,no surprise if you
théy do your beb inside and you hear bro
do your Own quick na i don dey on que
since... loool i.e no be only you get am
oh !""

IGBEYIN OJERE::

My fellow mapaite's how igbeyin ojere/
exam for your side nah?
.....................................................
Igbeyin ojere wey student théy broke don
Côme ,thé rate wey "konkobilo" dey sell
now no be small thing ,student wey get
small money go support am with "zobo"na
this moment your network provider go
dey send you message you go think say na
alart ,all is well exam go soon end lol...yes
na that how we roll ,so make una know now say 
Igbeyin no dey kill but make you
strong and in go wake your mendular.

STEALING UNION GOVERNMENT(SUG)

Kilode!!!Mapoly STEALING UNION
GOVERNMENT  (SUG)wey glorious be dem
oga claim dem sharp na to steal and carry
beb go bar una know abi una sama that fish brain with un à tinny and ugly oga 
waka 2million from sug account lool
,money wey students hustle to pay NA
dem gang an be pen warriors ..na so in
papa do jona wey 20million use leg waka
so we no suprise make una dey thief am
oh God dey watch una inside outdoor
média ..na cho thief they start oh na una buhari go soon jail!

EXAM PALAVA

sharp guys don résume dem work sha!if
you wan know if them sharp just carry
your phone Côme exam hall and your
money them go just help you keep am for
there bag i.e you no fit smell am again.so
bro ,sister keep phone for house oh!if you no
wan shout "OMG"some students talk say
na security dem ,dey steal am me no know
oh i hear ni oh LMAO.make una no spoil
mapoly image na our school dey top 3na 

FRESHERS ::

Loool mapoly fresh student don dey
lament say exam for mapoly no b beans
oh some don dey do "runz"to pass,freshers wey dey aim  upper crédit now
dem don dey pray to God for lower crédit even gan
pass , i remember wen dem résume na
selfie dem dey always snap dey tongue
out like cow wey dey hungry ,but now
freshers don dey post status like hanging
out with "Acc111"group reading on
point"lol dem get una NO where to hide
Mapoly no b fufu na to get thé admission na rice !.       

Mapoly woju version go come out soon
mo una support thé baddest crew in mapoly !west crew gang
(wcg)...na dem wan drop am #GBAM#

Make i drop pen hère jewe before i talk
pass My stature ........tori many catch ya
lewa!...gr8st OMO MAPOLY!!

Share on Google Plus

About Unknown

My Name is Olatunji Michael Afolabi Popularly known as Flowz. I'm a graduate of Moshood Abiola Polytechnic(MAPOLY), Abeokuta, Mass Communication Department. Disseminating Information and keeping students of the Institution updated has been my priority even before I became a Student of the Institution. This Blog was created in April, and many people has kept me moving through their Support, Motivation and Inspiration.
    Blogger Comment

0 comments:

Post a Comment